Peter Obi manifesto touch on security, economy, restructuring among odas – BBC

Wia dis foto come from, Peter Obi
In less dan three months to di 2023 general election, presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi, don release im campaign manifesto.
Di release dey come afta di long wait, tok-tok and different gbas-gbos among Labour Party members, opposition parties and plenti odas wey get interest.
Peter Obi announce di release of di manifesto wey im title, ‘e dey POssible: Our Pact wit Nigerians’, for im twitter handle early Sunday.
Oga Obi write say, “I dey honoured to present our 72-page Manifesto, title, ‘E dey POssible: Our Pact wit Nigerians.’ Dis Manifesto, im overarching and visionary policy plans, lay out our mission focus and mandate for securing, uniting and making Nigeria productive.
Di key highlights of di document na:
Peter Obi na politician and businessman.
Im na former govnor of Anambra state for southeast Nigeria.
E serve two term between 2008 to 2016.
Oga Obi bin dey All Progressive Grand Alliance (Apga) before e join PDP for 2017.
Im also be sabi pesin for wetin concern economy mata.
For 2019, e come out as vice presidential candidate of Atiku Abubakar. But dis year 2022 e don decide to go for di president position.
Peter Obi say im administration as president go create jobs, boost Nigeria economy, and improve education.
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *