Wia dis foto come from, Getty Images/Presidency
Nigeria central bank officially introduce di newly redesigned naira notes on Thursday, 15, December 2022 across di kontri.
Officials say di new ₦200, ₦500,and ₦1000 notes wey dem introduce go dey very difficult to forge.
While both di two notes -old and new – go still dey valid for now, Nigerians get until January 31 to exchange dia old naira notes before e expire.
Di notes wey currently dey in circulation na ₦5, ₦10, ₦20, ₦50, ₦100, ₦200, ₦500, ₦1000.
Aside dis newly redesigned bank notes, di apex bank also introduce new weekly cash withdrawal limit.
From January, dem say customers go only fit withdraw a maximum weekly amount of ₦100,000 naira for individuals and ₦500,000 for corporate organisations.
CBN say dem wan reduce di amount of cash wey dey in circulation.
Although many pipo believe say dis new withdrawal limit go affect some politicians wey dey like give cash during campaign and make am more difficult to pay big ransoms to kidnappers too.
E get those too wey tink say di new policy to encourage a cashless economy no too bam as Nigeria no dey ready for am.
CBN go carry di finished banknotes from Nigerian Security Printing & Minting (NSPM) Plc for distribution to all CBN branches.
Na di branch go distribute di banknotes to DMB wey be Deposit Money Bank wia dem go finally release am to di public through withdrawals.
CBN tell kontri pipo to deposit di old bank notes for bank.
Dem say deposits wey dey above ₦150,000 go attract charges.
Banks dey expected to keep dia currency processing centres open from Monday to Saturday.
All commercial banks wey currently get dis denominations of currency fit begin return di notes back to CBN wit immediate effect.
Wia dis foto come from, CBN
Five naira note
Wia dis foto come from, CBN
Ten naira note
Wia dis foto come from, CBN
Di ₦20 na di first Nigerian currency dem use polymer material do
Wia dis foto come from, CBN
Fifty naira note
Wia dis foto come from, CBN
100 naira note
Wia dis foto come from, CBN
Dis old ₦200 note go go out of circulation by January 31
Wia dis foto come from, CBN
Dis na di old design of ₦500 naira wey CBN dey replace
Wia dis foto come from, CBN
By January 31, dis design of ₦100 naira go expire
Wia dis foto come from, BAYO OMOBORIOWO
Picture of di new ₦1000, ₦500 and ₦200 naira
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.
New naira notes 2022: Nigeria money wey currently dey in circulation – BBC
